Guinea-Bissau don join kontris for West Africa wey military don take over dem govimet, cus as pipo like dem foma President Goodluck Jonathan dey wait to call di result of di election on Wednesday, military dey one said dey take over power.
As di case come belike that, ECOWAS come do quick emergency meeting online with President Bola Tinubu present, join with oda Heads of State and di Government Community of West African States (ECOWAS) on Thursday.
Wey di military take over, dem first arrest President Umaro Sissoco Embalo bifor dem announce General Horta Nta Na Man as di new head of di kontri for one year bifor he go hand over to anoda pesin.
