Wetin for turn to anoda set of problem for di kontri nai police don epp push away on Thursday for one Govimet Skool.wey dey for Odugbo inside Benue State.
Some men wey karey gun nai rush di skool student wey dey write dem Senior Secondary School West Africa Examination Council (WAEC) exam around 1:20 for afternoon.
Tori get am say di men wey karey gun na herdsmen and naso dem dey shoot everywhere, wey make di students and teachers start to dey run forforty.
Dem sha say na with di epp of 80 man Patrol Team for Benue State Civilian Joint Task Force wey dey for Odugbo nai sharply run down start to chase di gunmen, naso dem run enta bush.