+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gunmen Burn Army Motor For Aba To Force Biafra Day

Di Indigenous People Of Biafra, IPOB don bin tok say make nor bodi come out on May 30 onto say dem wan celebrate Biafra day.

To follow di order all shops, stores and anytin wey resemble business place nor even dey open as all of dem sitdon for hass.

But mata don dey turn one kind as video show wetin dey hapun for Obikiabia junction wey dey Agbor Hills for Aba, Abia State, cus gunmen don dey karey shoot sotay dem put fear for pipo bodi.

Di video show how di gunmen dey shoot army Hilux moto wey dey patrol come even set am on fire.

Cus of di way di gunmen take attack di military pipo for di area don dey fear say army go come back to attack dem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM