+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gunmen Kill Bomadi LG Chairman Officer For Ughelli Haux

Police dey find some unknown gunmen wey go kill inspector, O.O. Ojonogba, wey dey work with the local govimet chairman for Bomadi nai dem kill for August 25th.

‎Dem kill di inspector for di chairman haux for Ughelli, afta di chairman travel with di oda teree security men go Asaba come leave di remaining one with hin children for haux.

‎But around 3-4 for early morning wey di officer dey sleep for hin room nai di arm robas enta thru di generator haux wey dey on, shot officer aka Ade for neck as he dey sleep, nai dem pass di back from di dining, enta inside di haux start to dey shot di ceiling.

Dem come tiff phones and iPads come dey ask for moni and di children mama jewelry bifor dem come run ad dem nor see moni tiff.
‎As e dey now SP Edafe Bright say dem don start to dey look for di arm robas wey go kill officer Ade.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM