To make surr say everybodi sitdon for house nor go anywhere today Monday for Awka, Anambra State, gummen don go kill five pesin for Abatete, Abagana and Ukpo town.
Like around 8/10am nai dem first take reach Abatete town down teree pesin, two vigilante and di President General of di town but di PG dey for hospital dey battle between life and death.
Then for Abagana and Ukpo communities dem shoot one vigilante and one okada man die.
Tokpesin of Anambra Command , DSP, Tochukwu Ikenga, say de never know di real mata as tok never straight but he men don reach ground to gada all info.