+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Hand Go Soon Touch Loan App Wey Dey Do Online Burial For Pipo—FCCPC

You don ever hear or see loan app wey dey send threaten message give pipo wey borrow dem moni online? dat kind case go soon end cus Federal Competition and Consumer Protection Commission don say dem go close all those apps.

Adamu Abdullahi wey be di Oga of FCCPC say though say nor be dem right to tok about dis mata but all dis loan app pipo own don too much.

Bifor now many pipo don dey come out to complain say wey dem borrow moni from di app, if dem never pay na burial posters, calling of close friends and family members to spoil di pesin name, or even post bad information online say police dey find di customers.

Many pipo turn to all dis loan app online cus only one problem or anoda so dat dem for get urgent 2k to settle problem but right now di mata don be as e get.

Oga Abdullahi say dem agency dey do colabo with EFCC, and some other security agencies for di kontri to catch di online sharks since dem nor get office wey dem fit take go arrest but for sure, dem must get to di bottom of di mata.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM