One TikToker wey dem dey call Sule Yellow but di hakant he dey use for TikTok na @suleyellow6, but he work na to dey tok about teroris for social media but harmee hand don touch am.
Tori for X on Monday show say harmee watch Sule Yellow sotay dem come katch am afta he jus kolet moni from family wey he tiff dem pesin.
Dis Sule so dey very hative for TikTok dey show moni wey hin dey kolet from pipol family and he dey come TikTok live with some oda of hin bandits friends.
But as harmee hand touch am, dem come dilete di TikTok hakant and wan use am get odas.
