+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Harmee No Free Any Pesin From Easter Sunday Attack – Group

With wetin Nigeria harmee tok say dem don free 31pipowey bandits tiff on Sunday for Ariko village, Kacia LGA for Kaduna State, one komuniti group don say nor be true.

Di group President of Kuturmi Unity Development Association, J.D. Ariko, say wetin harmee tok na big lie cus till dis morning di victim dem still dey with di bad men cus di family don tok with dem and for phone inside di kamp.

Nigerian harmee never tok dem own side of di story afta di group say na lie.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM