+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

High Price Of Fuel For Akwa-Ibom, NLC Go Strike

As fuel price don go up for Akwa-Ibom state sotay e dey drag price with one paint of Garri say one liter pipo dey buy am for N2,500, Nigeria Labour Congress (NLC) don tell all civil servants say dem go enta strike and nor know when e go over.

Di strike so go start today Thursday, September 26, 2024 and other problem wey join for di strike na say Independent Petroleum Marketers Association (IPMAN), and Petroleum Tanker Drivers (PTDs), don bin get small issue sotay dem tell pipo to close deme filling station.

Govinor of di state, Pastor Umo Eno don bin say hin go do sumtin about di rise for pump price and punish any bodi wey dey sell above normal price but NLC say dem nor like di way di govinor dey behave like ogbolo towards di mata.

For statement wey NLC bring out nai dem say di Govinor don fail to take beta decision on behalf of di pipo and e go even beta make he set task force to check do mata of say army go seize tankers wey don already load with fuel.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM