+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

How I take try to kill myself for 2018 – Real Warri Pikin

Comedienne Anita Asuoha wen every know as Real Warri Pikin don let the world know how she take try to kpuff herself.

The comedienne for one Instagram post on Wednesday talk say she been wan denkwes becos of  N22 million debt.

When she dey share her story as dem dey mark the World Suicide Prevention Day, she come talk say she enter debts after one motivational speaker convince them to try many businesses.

She say she try to end her life so you no need to.

She say na for 2018, June 6, around 3pm nia she take attempt d suicide, say she give up on life because the wahala too much.”

Real Warri Pikin day life just dey knack for every angle, say life dey turn am round like barber chair, and say she feel say d only way to take end the pain na for her to just legoo.

Even as she dey encourage people wen dey reason to take their lives by themselves, she come talk say “….you wey dey look me wen dey get all those kind death thoughts, just understand life, say life must happen.

According to her, she say sometimes everything go legit for you, sometimes e go give you shovel make you go dig find your own chewing, she say make you build capacity and say make you tske am tuele tuele, one day at a time.”

Las Las, she come encourage those people wen don surve suicide to share their stories online.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM