+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

How Mosquito Take Save Ghana From Colonial Masters, Elder Statesman

One elder statesman for Ghana wey be Dr Nyaho Nyaho-Tamakloe don tom how do kontri take safe from white pipo hand afta independence.

Di man wey join pipo to start New Patriotic Party, NNP, say di way South Africa take sufa for di hand of white men cus dem dey see dem les les for be di same tin for Ghana if not for mosquito.

According to di interview, he say British colonial masters don already create dem own quarter for Ghana and if you nor be white, dem no born you we to near there.

Nyaho-Tamakloe say di white wey stay back afta di independence choose fine side of Ghana and for there dem get their own bus station, police station, post office and anytin wey you dey find.

Di tin wey come make dem nor fit stay na di mosquito wey come dey bite, kill many.

He come still say just Ghana nor be like Kenya wey dem weather dey cool, na di kind mind wey British karey take folow South Africa nai dem get for Ghana too, but na mosquito nai come save Ghana from that plan.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM