+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Hunger Protest: Senator Ireti Kingibe Say Wike Dey Waka Spoil Her Name

Di lawmaker wey dey rep Federal Capital Territory, Senator Ireti Kingibe, dey shout say pesin dey korokoro wan spoil her name and nor be any other than FCT Minister, Nyesom Wike.

She say she nor go sitdon look make pesin dey karey fake news waka about her cus na di tin she nor fit take.

Wetin bring di mata be say Wike say one senator dey sponsor di protest cus di pesin karey good dey give dem and security go soon call am to know why senator go dey work against di govimet.

True say Wike nor call anybodi name but Senator Kingibe say na she nai Wike dey tok to base on one video wey Peter Obi join with other top Labour Party members dey tok to protesters wey deg vex say dem wan sack Julius Abure, LP National Chair.

Even sef, Peter Obi don dey shout he own for one side say make nor bodi dey point hand give am say na him deg sponsor protest wey he nor know any tin about.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM