Rotimi Amaechi wen be d director general of the reelection campaign of President Muhammadu Buhari talk yesterday about how he take enter 10-month exile for Ghana for d year 2006 when before before Presido Olusegun Obasanjo dey for power.
Wen Amaechi dey explain wetin he pass thru, he come tackle Obasanjo for d way wen he take talk say President Muhammadu Buhari don return Naija to the “Abacha era”.
He come tell Nigerians to compare the administration of the Peoples Democratic Party (PDP) to dis present administration and say make dem decide which one dey closer to Abacha government.