Di upandan wahala wey dey between Afe Babalola and lawyer Dele Farotimi wey dey like do activist work, be like wetin go soon end.
Remeber say Babalola karey Farotimi go court say, book wey di activist write dey talk bad about am and Magistrate Court for Ado Ekiti to punish am but now he don change mind to komot mata from court.
Na afta di Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, go visit Babalola on Sunday nite for hin house join with other traditional rulers.
Wey dem dey tok nai Babalola say many pipo even foma presidents don beg am and so he nor get choice but to listen to everybodi.
He say e nor get anytin wey he wan gain if Farotimi go stay for prison so him go tell him lawyers make dem komot di case from court.