+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

‎I Like As I Curse Ezekwesili — Senator Nwaebonyi

On Tuesday nor be small gbege wey nearly lead to red eye nai hapun for di committee wey dey look into di mata of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey say Senate President, Godswill Akpabio eye dey her bodi, bifor you know shut up don dey fly for air between foma Minister Obi Ezekwesili and Senator Onyekachi Nwaebonyi.

‎Dem two don start to troway word as Nwaebonyi say Ezekwesili na disgrace to womanhood and get yeye lifestyle afta he say Ezekwesili tell am make he shut up and call am yeye pesin.

‎But for Channels TV on Tuesday night, di Ebonyi North Senatorial District Senators say he nor regret wetin he tok as na Ezekwesili nai first open mouth curse am and as grandmama nor get respect for hersef he nor go respect her.

‎He say dem call di foma Minister go come take oath as witness but she say she nor dey do nai him say he go do am to give evidence but instead of that Ezekwesili come say make he shut up, yeye pesin dey tok.

‎Nwaebonyi say he respect Ezekwesili as woman, but she nor get di right to tok to am like that for public.


Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM