+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Be Okowa Boy Boy – Gov. Oborevwori

Govinor Sherrif Oborewori don come out to tok make pipo nor dey say na foma Govinor Ifeanyi Okowa nai dey tell am wetin he go do.

Na for Thanksgiving service wey di govinor go do on Sunday for Living Faith Church for Ibusa Asaba, na there di govinor say pipo dey tok upandan about he administration say na boy boy hin be to Okowa.

But Oborevwori say nor be so cause na only advice nai Okowa dey give am and he don epp wella but that one nor mean say he dey influence him decision making.

For the service nai di govinor say na God dey run tins for an camus since di struggle wey start from di party primary to di election come make am Govinor, he say ha God hand dey inside.

Oborewori con me open up say from now dem go start to open di new projects wey dem don do for di whole world to see how dem don work for one year inside office.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM