+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Dey Run O, Britain Man Wey Police Say Dey Plan To Remove Presido Tinubu

Di British man wey be Andrew Wynne and Nigeria Police say dem dey find him and one other Nigerian man Lucky Ehims, cus dem two dey plan to porchu Presido Tinubu komot from govimet seat, don come out tok about di mata.

Na N20 million nai Nigeria police put for di two men dem head to give anybodi wey git bring information give dem according to statement wey ACP Muyuwa Adejo, di Force Public Relations Officer tok.

But for Channels TV interview on Monday nai Wynne take say he nor dey run from anytin and he don dey stay for Nigeria more than 25 years now.

Wynne say as he dey so he ready die to tok with Nigerian police, cus di lie for he head to big. As he go just sitdon say he wan folow scatter kontri wey he dey always visit and he even gets bookshop for NLC building for Abuja for more than 7 years now.

He say he nor dey run and ready to go meet officials of Nigerian High Commission for London make dem tok and even sef police for Nigeria fit folow am tok for WhatsApp or even zoom.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM