+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Fit Pay My Four Drivers N100k , SGF Gorge Akume

For meeting wey Seketary of di Federation, George Akume do with some Christian group on Thursday, na there di SGF come dey tok say he nor go fit pay N100k s monthly salary to hin drivers.

Akume say make di group support govimet so that di new minimum wage wey dem dey tok with Labour pipo, dem fit accept am cus e nor go easy for govimet to fit dey pay that kind big moni.

Di SGF say hin get four drivers and dem get pipo wey dey depend on dem and paying N100k go too much for am to pay.

He say Govimet don dey look as dem go fit take build cheap houses for different part of di state, cus dem don dey gada land tonuse build wey go dey cheap.

But for now afta Finance Minister Wale Edun don go submit di minimum wage template to President Tinubu on Thursday, workers set wait to hear di amount.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM