+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Go Allow Niger Speaker Do Marriage For 100 Girls, Ministry of Women Affairs

Di order wey di speaker of Niger State House of Assembly give say all di 100 girls wey dem mama and papa don die for Mariga LGA wey bandits kill, make dem ready dem for marriage.

Di Speaker, Abdulmalik Sarkindaji, say na hin own way to epp reduce suffa wey di young girls dey go through for him constituency and nor be only that one he go still epp di groom pay di bride price join with other marriage tins.

But di message nor go down well with di Minister of Women Affairs Mrs Uju Kennedy-Ohanenye as she don write letter go give di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun make dem tell court to stop that kind marriage.

Di project wey di speaker for Niger wan do so na for May 24 and Mrs Uju tell tori men for Abuja say dem don go meet court to give paper to stop that kind tin and na by force.

She say e nor make sense cus all those girls fit like to go Skool or even wan learn work and dem nor even know how many y di girls dem be, nai make dem wan investigate to know.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM