+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Sponsor Marriage Again, Uju Go Epp Di Children For Niger — Niger Speaker

Speaker wey dey for di House of Assembly for Niger State, Abdulmalik Sarkindaji, don provoke say he nor dey do di weeding of di 100 girls for Mariga LGA wey dem bin plan fof May 24 again.

Di man say he nor just happy with di way di Minister of Women Affairs,  Mrs Uju Kennedy-Ohanenye, take go about di mata without say he nor call am first,but she dey for Abuja dey see wetin dey hapun insidr IDP camp fod Niger.

Sarkindaji say nor be bad thing he wan do but he only dey follow dem tradition and religion wey dey forbid say girl wey don suppose marry go dey do ashawo work or dey waka upandan for street.

Nai make wey 270 girls come meet am say make he epp dem do marriage, nai he go tok with religious leaders and traditional rulers to know how far which dem accept but hin say na only 100 of dem nai he hand fit karey.

Do Speaker say some of di girls parents dey even urge for di marriage but as e be say di Ministry of Women Affairs dey threaten am, he nor go suppose di marriage again but only give di parents moni, make only Uju come Niger to epp di children with wetin dem dey find.

Na yesterday nai Uju Kennedy-Ohanenye say she don tell court and IG of police say make dem go warn di Speaker of Niger State not to marry 100 girls out cus some got wan go skool, learn work or deme never even reach to marry.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM