+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I See How E Pain You: Tinubu Tell Ayuba Mama

President Bola Tinubu don go Jos go visit di pipo of Angwan Rukuba wey men on gun delete 27 pesin on March 29 wey be Palm Sunday.

Naso Presido dey tell di pipo make dem nor cry hagain, come tell woman wey video trend as she hold her son Ayuba wey dem just kill, day everywhere go laslas soft.

He tok say “Dis tin wey hapun, nor go hapun hagain. Na me cus am. I know how e dey pain you. I see di video wey you owe Ayuba dey cry with pain.

“But na only God go fit give you joy and konfot. No moni fit pay all of una. Yes as govimet we go try awa best to konfot una.

Presido come say “Di best solution na for dem to get justice, so dat di world go be like were pipo like us grow.”

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM