+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ibeno Beach Welcome Landmark Resort To Akwa-Ibom

Afta Federal Govimet don scatter Landmark Hotels and Beach Resort wey dey for Lagos State cus of di Calabar coastal highway wey dem dey build, di business don change location to Ibeno beach wey dey for Akwa-Ibom State.

Landmark management meet with di Chairman of Ibeno Local Government, Rt Hon.Elder Emma Ibok with other pipo wey dey on ground as dem dey resi  where to mount di resort put.

Even di Akwa Ibom State Commissioner for Tourism, Charles Udoh, folow join welcome Landmark, say dem go enjoy their stay for Ibeno join with di development wey di state go still get from di investment.

Naso Ibok come dey greet di State Govimet, Pastor Umoh Eno and promise to work with di stakeholders so that dem go dey okay for di state and even di youth of Ibeno go put hands togeda cus na way for dem to get work too.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM