+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

If Protest Bloody Govimet Nor Go Take Am — Presido

Warning don dey come again and again to pipo wey dey plan for di August 1st protest make dem nor go destroy property or even cause death of any pesin.

On Thursday wey President Bola Tinubu dey tok with APC govinors nai he take say he nor go sitdon look make wetin hapun for Kenya come repeat for Nigeria.

For di meeting wey even traditional rulers join for di presidential villa, dem dey try to see say di protest nor hold.

Bifor now govinors don dey warn and beg protesters say make dem nor go for di rally cus everywhere don dey hot already and Nigeria nor need am come join with di Defence Headkwatas wey say jaguda dey plan to cus problem for di protest.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM