+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

If Una Wan Komot From Awa Land Make Una Komot Di Pipeline, Ogbe-Udu To NPDC

Ogbe-Udu communiity for Udu, yester enta street dey protest against management of NPDC, NEPL say dem wan karey di flow station komot from dem village.

Na yesterday Monday morning nai dem do di protest say if really say NPDC and NEPL wan komot from dem village go Emadagja make dem still komot di pipeline wey dey for Ogbe-Udu communiity

Na different poster dem karey take dey display say afta di company don use Ogbe-Udu for 42yrs finish dem wan change to anoda community, e nor go work.

Wey di President General of Ogbe-Udu, Mr. Joseph Eni dey tok to news pipo hin say dem do everytin to protect di land make nor bodi enta for 32 yrs and even di original pipo wey get di land nor farm put, but now dem dey change story.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM