Some protest pipo don line up for Independent National Electoral Commission, INEC, headkwata for Abuja, say dem nor want Mrs. Oluwatoyin Babalola to be di Resident Electoral Commissioner for Ondo State again cus dem nor trust her.
Di pipo karey different kind of card write say wetin hapun for Edo State during di Govinorship election, dem nor want that kind play for Ondo State even though say dem nor get problem with di REC.
Bifor dem dey come out for protest, Govinor Seyi Makinde of Oyo State tok some days ago say di kind relationship wey di REC get with APC, go make tins hard for di state election cus di REC oga fit run wetin hapun for Edo for Ondo.
Wey INEC National Commissioner, Major General Modibbo Alkali (retd), come dey folow di pipo tok, he say make dem nor worry say di Commission go resin di mata wey dem karey come give dem.