Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, (IPMAN) don give Govimet 7days to corporate and pay dem N100 billion or ready to dance to any kind music wey dem do play give Govimet.
IPMAN tok thru di Chairman of IPMAN Depot Chairmen Forum, Yahaya Alhasan as dem dey ask Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority, (NMDPRA) to do wetin dem tok or di whole kontri nor go get fuel use.
E don reach 40 days wey govimet tok for di present of National Security Adviser Nuhu Ribadu say dem go do sumtin and notin don hapun cus even depots for North and Jos like Gusau, Minna, Suleja, Kaduna, Kano, Gombe, Yola, and Maiduguri, never fit dey work cus of di gbese.
Alhasan say na 7 days nai dem give NMDPRA and if dem nor pay di whole kontri go hear am for bodi as dem nor go see petrol use for anytin.