+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

IPOB Make Una Ready Cus We Dey Come For Una – Nigeria Army

Nigerian Army say dem must show shege banza to Indigenous People of Biafra, IPOB cus of how dem  go karey kill five of dem men for Obikiabia junction wey dey for Aba, Abia State yesterday.

Di provocation dey for statement wey di Director of Defence Media Operations, Major General Edward Buba sign come show tori pipo.

Dem say their eye dey red cus as di sojas karey die dem nor fit let am go like that, cus na checking point wey dem dey nai di IPOB karey demsef go attack di sojas burn motor and kill five.

Army na say na mourning stage dem dey and dey do investigation but make IPOB/ESN ready for dem cus afta dem investigation na wotowoto nai dem go release put for dem bodi.

Remember say we tell you yesterday wey be May 30 say, IPOB bin give order say make nor bodi waka as dem dey celebrate Biafra day for di whole south east bifor dem come go roast sojas for Aba.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM