Iran don use missile scatter US oil tanker wey dey for Persian Gulf and dem say di tanker burn reach ground.
Na Iran Revolutionary Guards nai tok so for statement inside dem state Tv.
Bifor di strike for di tanker hapun Iran don warn US say di reggae wey dem start make dem ready ti dance follow.
Di tori dey go one kind but Guards don say na dem get full control of di Strait of Hormuz, wey dey konet Gulf to Indian Ocean and na very important place wey oil and gas dey pass.
