One Nigeria pesin don join di plenty pipo wey wound for United Arab Emirates afta di many bomb wey Iran dey send go di kontri cus of dem fight woth US.
Wetin UAE tok on Tuesday and Wednesday from dem Ministry of Defence say na total of 262 ballistic missiles nai Iran don fire enta dem kontri since di fight start on February 28, but dem catch 241 for up then di oda 19 land for sea.
But were bad na two of di bomb wey fall for di city come make six pesin kpai, 122 wound, and Nigerian pesin join those wey wound.
