Jos Women for Plateau State nor dey take am easy hagain for insecurity as kristain and morslim young women wey reach like 20 don form vigilante group.
Di leader of di group na Blessing Ngozi Emmanuel, she say dem nor dey resin sleep but all na to see say dem shidren and komuniti dey okay cus govimet don fail dem plenti time.
Na around 9 and 1 for night di women dey enta bad places and di work don make some injure odas don get warning from bad guys.
But di woman say dem not mind di danger but make govimet give dem hand for wetin dem deg do for di komuniti cus na just naw di LGA officials come see dem even thou dem non dey work for months.
