+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

JUST IN: Wahala For Rivers State Afta Opening Of LGA

Anoda gbege don burst out for Rivers State for Ahoada East secretariat wey be di LGA of Edison Ehie wey be di Chief of Staff to Govinor Siminalayi Fubara.

Di problem na sake of say some pipo say lie lie di new chairman nor go enta di office to sitdon do work.

Know say afta teree months wey dem clos LGA secretariats for Rivers state na today Monday nai Inspector General of Police, Kayode Egbetokun tell di CP for di state to komot di ban.

But day never even finish, na koko-tasatasa from police nai don porchu pipo go hide head for one cus of say jaguda one turn di tin to anoda tin.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM