Govinor Kabiru Abba Yusuf of Kano State, don tell di state hakant general make he sharply close all di hakant of ministries, agencies and departments for di state.
Na wey dem dey do meeting for di State House with Chairman of Kano State Internal Revenue Service and head of MDAs nai Govinor Yusuf take give di order.
Di resin of closing di hakant be say make govimet fit know wetin dey enta, calculate am and use am take do development for di State.