+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kenneth Okonkwo Be Like my Junior Broda — Peter Obi

On Sunday nai di tokpesin of Labour Party for 2023 presidential election campaign, Kenneth Okonkwo say he nor fit do tins with di party again.

Okonkwo dust he slippers afta he don share he mind for letter inside social media say he nor near Obidient Movement or di party again.

He say na Peter Obi head nai he put all di blame pass cus he never fit stop all di problem wey dey di party.

But Obi don come out to tok how di colour of hin belle be for di mata say even though Okonkwo nor wan join again, he nor go look am with yeye eye.

On Monday wey di tokpesin of Peter Obi during di 2023 presidential election, Yunusa Tanko dey tok nai he say di foma Govinor nor too vex but see Okonkwo as he junior broda.

He say where Obi and Okonkwo nor gree na di style and manner wey dem take dey handle issues for di party and not be personal problem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM