+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kenya Plan Tax For Pipo Wey Get Possy

Pipo wey like cat for di East African kontri Kenya nor just dey happy with di new bill wey di kontri dey try to put for dem cat bodi.

For Nairobi City County, dem don dey think to bring law sat anybodi wey get possy must vaccinate am and even register di cat but di owners dey still fear say cat na animal wey nor dey hear word.

With di law, pesin wey get cat go pay reach 200 Kenyan shillings ($1.50) to get licence for dem cat and still show proof say di cat don take rabies injection.

According to di City Animal Control and Welfare Bill, any pesin wey cet possy make dem make sure say di cat nor dey cry disturb neighbors or else na di owner go face di music if di cat nor hear word.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM