As na sleep and wake hear say one attack, killing or evil don hapun for different part of di kontri, nai make senators now don put law say any pesin wey dem catch for kidnaping business, na straight death sentence, no abeg of any type wan save di pesin.
On Wednesday wey di lawmakers dey tok on di mata, nai dem say di Senate joint committee on security go start investigation on who give order make military komot from govimet girls secondary skool Maga, for Kebbi State, bifor di bandit come attack.
No be small blaming and tension dey di red chamber afta Senator Yisa Ashiru from Kwara South move di motion say wetin dis bandits dey do for where pipo dey go pray and local communities, don pass be careful.
