No be small fear dey catch pipo wey dey stay for Bomadi and oda communities wey dey around cus dem nor know how army go behave towards dem afta kidnapers go tiff one senior officer, Lt.-Col. Josiah for Bomadi.
Di Colonel bin go Kpakiama for marriage party during di weekend but as di marriage finish nai he go lodge for Bomadi, but around 2:30 early mormor on Monday, 8th September nai Kidnapers bust di lodge.
Dem enta every room dey find even kolet dem phone bifor di kidnaper tiff di Col. Josaih put for motor wey dem karey come.
As mata bust naso Joint Task Force and sojas for Bomadi Division come dey find everywhere bifor dem see di di motor wey di kidnap use take tiff di Colonel for Tuomo community near Tuomo-Ogbobagbene-Tamigbe-Torugbene-Ojobo road.
Wetin one soja pesin tok be say dem don karey di motor go di military base wey dey for Bomadi-Overside but dem still dey find dem oga.