+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kidnappers For Upper Agbarho Run Afta Police Enta Dem Bush

Police don scatter plan of kidnapers on January 11 around 9:35 for nite as dem enta di kidnap den, recover many tins plus plate of soaking garri.

Na for statement on Tuesday, wey SP Bright Edafe di PPRO release, nai he take say na di CP Special Assignment Team nai go karey out di operation afta dem gey infor say some kidnaper dey hide for bush wey dey along upper Agbarho for Ughelli.

As di kidnaper see di police and di vigilante wey dey follow dem, nai di six of dem start shoot but police give dem wotowoto nai dem run with diffraction wound for bodi.
Wetin police come see for di scene na one plate of soaking garri with 3 spoon, plenty nylon of groundnut, nylon of garri, scahet of ogogoro, lighter, matches, one FNC gun wey dey loaded, bullets, one pump action gun with 32 live cartridges.

As di kidnapers run, police don dey find dem but wetin dem recover from di scene dey police office.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM