One craze wey dem never know who di pesin be don go kill teree children wey dem papa and mama leave for haux on Saturday for Nnewchi, Nnewi, Anambra State, come put di deadi bodi for freezer.
Di children wey dey do man server work for church na The children, 9 years Ejezie Chikaima Davina, 7 years Ejezie Chinziterem Dominica, and 5 years Ejezie Chimdilim David.
Dem mama wey be nurse and dey do lecturer work too, nai leave di children fkd haux go write exam on Saturday February 1, 2025, but as she come dem haux door open for ground and normally do children dey lock door if dem dey go play.
Na do papa of di children Ejezie Udochukwu Samuel, wey dey work for Irrua, Edo State, nai karey di mata come outside for post about wetin hapun to dem as family.
He say according to do wife wey call am on Saturday, say she start to find do children sotay she find dem reach church but nor see dem, until pipo come dey find enta fridge na there dem see di teree children deadi bodi.
Police Dom put bodi for di mata as di Police Public Relations Officer for Anambra, SP Tochukwu Ikenga, say dem don start investigation and even karey am to SCID cus di CP say dem must find who kill di children.
But small insight wey dem get be say, do pesin kill di children bifor e put dem for di freezer cus food wey dem dey chop just dey for ground.