+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Konga Foma Oga, Nick Imudia Kill Hinsef For Lagos

Pipo wey sabi business for Nigeria get shock for dem bodi afta di news of di Chief Executive Officer of D.light Solar Energy Solutions, Nick Imudia, wey be foma CEO of Konga.com die for he mansion for Lagos.

Tori just lnd say di Imudia karey hinsef go di front of e balcony for he Lekki hass, look up, look down jump go down to kill hinsef.

Dis 54 years man na from Ika South LGA for Delta State and he bin marry to he small dauta mama wey still from Ika bifor di marriage come sactter.

He family, friends and close business pipo still dey wonder wetin make di man go kill hinsef on Tuesday, June 25.

Mata say, bifor he die, Imudia call he broda wey dey obodo oyibo US, to tell am hoe he go use share and manage he property if anytin hapun to him.

He come still call he lasty pikin tell am say if she dey find am, make she look sky he go dey there dey see her.

Police don dey do investigation now to know di resin way make di man jump die.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM