+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kopa Elohor Don Tok Wetin Agunechemba Do Her For Anambra

‎Di National Youth Service Corps member, Jennifer Elohor Edema, wey Agunechemba security operatives use beating and kposing take finish, don tok wetin hapun to her to Kpoko FM own Aprokoking.

‎Elohor say wetin hapun for dem kopa lodge for Oba, Idemili be say dem first think say na dem neighbor door cus na terre storey buildin, nai she come go check but bifor she reach di door dem don already kick am.

‎One man wey wear mask enta with gun, nor wear uniform, dem con think say na army robber until he say make all of dem come outside. Nai Elohor come dey try tell dem say dem be kopa wan show ID card but dem nor wan hear anytin but dey scatter tins.

‎Dem come almost troway her downstairs dey ask wetin give her di right to ask dem kwestun, na wey dem reach down nai dem take know say na Anambra vigilante group.

‎Di kopa and her family say dem want justice as dem tear her clothes even use iron take knack one of her fellow kopa. Naso dem take press her head, neck, slapping and say if she try call anybodi dem go scatter their phone.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM