+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Labour Make Minimum Wage Nor Go Down Pass N250k, Timi Frank

Foma Deputy National Publicity Secretary of APC, Comrade Timi Frank, say make Labour nor give Federal Govimet di change to reduce moni wey dem wan pay workers as new minimum wage.

Na for statement he take tok so on Friday for inside Abuja as Frank come dey acuse President Tinubu say he nor just dey do well, why he go sharply to increase judges salary but di small minimum wage wey workers dey ask for he nor fot even resin to attend to am well.

He say make Trade Union and Labour Congress to nor kolet anytin less than N250,000 to make sure say dem fight very well for di ordinary worker wey nor get mouth to tok.

Na Frank come point to di judicial and legislative arm of govimet say if dem want make tins work na to reduce dem salary and wages so that e fit accommodate di poor worker wey nor dey fit see good eat well for one day.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM