+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Lady Sell Small Broda Use Money Give Boyfriend

Adamawa State Police don catch one girl wey dey stay for Mubi  afta she don sell her small broda for N410k.

Blessing Okonkwo na 24 year wey just pretend go karey her teree years broda from her mama, Hauwa Lawan, wey dey stay for Rimirgo inside Askira Uba Local Govimet Area for Borno State say she wan go put am for skool.

Di mama come dey suspect say tins nor dey okay, cus she go call Blessing, give phone to di small boy, na one excuse or di other nai dey folow.

Na Lawan come dey suspect rough play, karey di mata go meet police, na there foul nyash come open as di mama even shock say her own dauta go sell her broda to pesin wey she not know.

Wetin Blessing confess be say, she see pesin wey wan buy pikin nai she sell her teree years broda to Efunaya Nabufe, for 410k naso di buyer karey di pikin to Enugu State.

She say she use am buy grinding machine to take start business and give di balance N200k to her boyfriend wey he fo use take buy items inside di list wey family give dem for marriage.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM