+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

M23 Rebels Say Dem No Wan Fight For Goma DRC Again

M23 rebel group wey di kontri of Rwanda dey back to fight Democratic Republic of Congo for di eastern city of Goma say dem nor wan fight again cus of human being sake.

‎Many pipo nai nor get where to stay again since di fight for Goma start and di place na one of di place wey get beta mineral resources bifor dem come annonce on Monday say dem nor wan fight again and di Congolese govimet never talk about am.

‎On Monday nai U.N. tokpesin Stéphane Dujarric tok about how tins dey go for Congo and how health problem don dey rise.

‎According wetin UN refugee agency report tok since di fight start for 2025, more than 400,000 pipo nai no get haux again, 900 don die and 2,880 nai don wound with G7 nations and EU dey condemn why Rwanda go dey enta anoda pesin kontri.

‎But afta di announcement wey di M23 rebels do, di Congolese govimet never put mouth for di mouth.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM