+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Only We Fight Boko Haram To Avoid Problem — Defence Chief

Make una make military get beta guns to use instead of to bring outside military to epp fight. Na wetin General Christopher Musa, the Chief of Defence Staff, tok as he dey reply wetin Senator Ali Ndume tok.

Ndume bin say make dem go outside bring military pesim wey go epp fight Boko Haram especially cus of di pipo wey die for di new attack for Ngoshe inside Borno State.

But for Arise TV show nai Musa take say e nor go make sense say dem wan bring military from outside cus if dem look di example of Mali and Iran di result nor end well laslas.

He say one problem wey dem dey get na informants wey dey send info to Boko Haram about dem way but with how colabo dey with American and European kontri for training tins go soon dey alright.

Musa come say make Nigerians pipo get patience small with military cus dem dey try dem best and e even beta pass as e be bifor.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM