+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Ask Kwara Govonor As Bandit Take Get AK-47 From Him — Foma Lawmaker

One foma House of Assembly member from Kwara State, Mashood Bakare, don say make dem nor use play eye take troway wetin some bandit tok say di AK-47 and patrolling van wey dem dey use na Kwara govimet buy give dem.

On Sunday nai Bakare dey tell federal govimet and Nigerians say e nor go make sense say dem nor investigate dis kind tok as insecurity just dey rise like garri for di state.

But for di oda side di Chief Press Seketary to Govonor Abdulrahman Abdulrazaq, Rafiu Ajakaye, say wetin di bandits tok for di video nai big lie cus wetin dem tok for Hausa, say na from Abuja dem take dey get weapon.

For di 36 seconds video, one of di bandits wey soja dey ask am say di motor and guns wey dem dey use na Kwara govimet give dem and dem don dey patrol di area dey hide like say dem be security pipo for some time now.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM