+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

‎Make Una Come Invest For Delta, Oborevwori Tell Sweden Investors ‎

Delta State Govo, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori, dey spin Swedish investors make dem make use of di opportunity wey dem get to take do beta investment for Delta State as di place get enough natural resources.

‎Na wey di Swedish Ambassador to Nigeria, Annika Hahn-Englund, with her pipo come visit Govinor Oborevwori for Govimet House on Tuesday for Asaba nai he take tok so.

‎Oborevwori tell dem sag enough oil and gas dey do state and if dem invest for di state dem go gain am as di two nites wey dem sleep for di state notin hapun to dem.

‎He come dey use sweet words dey tortori di ears of di Sweden pipo, say airport dey for Asaba, Osubi/Warri and Escravos then places like Kwale free trade zone, Koko free trade zone and the Ogwashi-Uku Agro Industrial Park na places wey git benefit too.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM