On Saturday nai sojas wey dey porchu yahoo boys go use mistake kill one biggie belle woman for Abraka.
Dem say di sojas stop di yahoo boys motor but dem nor gree, naso sojas stat to porchu dem, come dey shoot gun against dem, naso one of di shot take touch di pregnant woman wey dey on her own kill her instanter.
As di tin hapun nai protest bust out from students and pipo wey dey stay ABK against di sojas but Govinor Sheriff Oborevwori on Sunday, say make pipo calm down as justice go come for di pregnant woman.
He tok dis one thru he Chief Press Seketary, Sir Festus Ahon, on Sunday for Asaba, say wetin di sojas behave dem for fit avoid am if only dem use sense work but make di family mind come down cus di case now dey under investigation.