+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Nor Kolet Any Cybersecurity Levy, House Of Rep Tell CBN

As many pipo, join with organization and group dey complain about di 0.5% cybersecurity levy wey Central Bank of Nigeria, CBN, say dem go dey komot now from pipo moni wey dey for bank, House of Representatives done tell dem to stop dat kind waka.

Know say CBN don send message give all banks say from on di 6 of May wey dem bring di circular out two weeks time make dem start to kolet di levy from all transaction wey customers dey do to other banks.

But wey di House member wey di rep Obio/Akpor Constituency, Kingsley Chinda, say make dem take dat kind word back cus he nor make sense.

Chinda say pipo don dey struggle to get dem sef to stand afta subsidy, dollar naira dey show pipo shege, e nor go maoe sense say na now CBN go come dey put Cybercrime Act to work.

Nai all of dem take gree say make di cybersecurity levy fee nor work now, so that tins nor go bad pass as e don already be.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM