+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Stop That 18 Years Admission Mata, Court Tell JAMB

Afta Joint Admission and Matriculation Board, JAMB, don do di one wey dem know say any bodi wey dey find admission to university must don reach 18 years first, one foma Nigeria Bar Association Chairman for Warri branch come vex drag JAMB to court.

Barrister John Aikpokpo-Martins, say he nor happy with wetin di board even tok say di restriction na for next year pipo wey wan write JAMB nor be dis year student but lawyer nor gree he drag JAMB and Edwin Clark University go Delta State High Court in Warri.

For jorjimet wey di court come give, nai nai dem tell JAMB make dem nor even resin that 16 years mata for any skool wey dey di kontri and just wait till dem hear any other tin about di mata but for now dem don troway am for bush.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM