+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Uvwie Task Force Stop To Tiff From Pipo, Activist

Di way Uvwie Council Task Force dey take hustle pipo moni wey dem suffa work for Uvwie don dey turn anoda tin, as pipo don dey shout make di chairman do sumtin.

One woman Eseoghene, case nai just bring mata out as her 300k enta some officials of Uvwie Council Task Force hand, bifor Ossai Ovie come call Israel Joe wey be activist make he go check di mata.

Joe come tok for statement say he don kolet di 300k wey di Task Force kolet give am back to Ese.

Naso di activist, come dey tell di Chairman of Uvwie Local Govimet Council make dem tell dem task force to stop di tiff character cus na wetin law call criminal.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM